You'o dey dey di shidon you quiet quiet Dem go promise for helep you tanap me ya head go air. No hear you notin because true true so dem di eye na ya chair. Na so dem be brain wa papa dem say for live inside mud ntang na suffer. Turn turn dig wa gran gi we small cement then tif wa gold for backside. Wa papa dem be too lef de gran for di mendem because de oversabi dem com talk say for work farm under sun over worry. Say make we, number tiri world pipo, daso tie rope for neck like dem go jar big big book. Time don pass now dem say if we no start plant tin dem back, sun go com burn dem all plus we too.
“No over check da December bushfaller dem Na die body dem di com wash for here.” No hear you notin! If ya strugggle nova yet jam any man, Askam for shift me you pass. At least de tin don gi you small money for go salut family. Di one still dey bush on top da yi 10-yrs-masters di jist we kankan tory.
Ma pipo, time no dey for check all da achombo talk dem: “Any man wey no di cheat no get balls.” Brodaman, jo tell yi say e still remain you de main canda wey odas di cheat witam. “Woman dem di ever make mop plenty na when no man nova yet toucham.” Wee done! Baby, di one don touch touch young gel dem sotey make survey com preach for here. Tell yi say yi di worry na worry because Yi no go touch you; no hear you notin!
“See Amadou too for chop pork pass me sotey lik mop.” Pepper no bi sef dey dey, why e hot you so?! Eske na for ya nose e go smell time wey yawa com gas?! “Eding don married, yi no get to di dress so for go bolo.” Na surely why dat wey yi no marry na you. Why you dey so so charge pass yi massa?! “Fon too don married but yi di still enter kitchen. Woside yi woman go?!” Dey you dey! Na so Adam be shidon, snake com gi yi and Eve correc chop noo Amadou, Eding, Fon, me wuna no hear notin!
Na so dem be too tell ma man Chila say mi comot da oyibo company, Sika say man no fit ever get plenty money as employee. Chila dey here now di worry place say yi be CEO for Pear Juice & Co. Na tiri years dis don pass wey budget no di gree com see yi Oh Chila why?! Why you no go too check sense before you gree dis tins? Now wey you dan see sometin, Abeg next time no hear you notin!
Some oda one too na Nji. A memba how dem bi tell yi say as correc man pikin Yi get to di go mbu hass shak mimbo wikop yi esprit Na da very esprit don di nan inside gutter sotey piss, Especially time wey da gran ser dem no dey for take junk fee. Nji yi mami pikin di ever jo cry yi time wey unku enter da tin say hass for sharp sharp morning shidon cona bed with da trong num for skin. She no go sef gree look yi time wey yi ask da tin. But na instead da time wey ya man no go hear yi notin!
- Roy A. Ngansop
* REMEMBER POEM WITH THE HIGHEST SHARES WINS SO IF YOU LIKE THIS, PRESS THAT SHARE BUTTON.
